For di second time inside di month of October 2024, di Nigeria National Petroleum Corporation Limited (NNPCL) don adjust dia pump price of Premium Motor Spirit (PMS) – wey pipo know as simply petrol.
Dis na di fourth time petrol price dey increase between May 29, 2023 and now. But in spite of di increase in price, fuel queues still dey for some stations for Abuja and Lagos…….CONTINUE READING
BBC Pidgin notice say di price of one litre of petrol for NNPC fuel stations for Lagos na N1,025 wey be 27 naira increase from di former price of N998. For Abuja, di price rise from N1,030 to N1,060, wey be 30 naira increase.
As usual, other major petroleum marketers don also jerk up dia pump prices.
Dis development dey happen after just about two weeks wey di NNPCL begin sell petrol for N1,030 on October 9, an increase from N897.
Petrol price for Nigeria bin dey at N197 per litre until President Bola Tinubu announce on May 29, 2023 say goment no go dey pay petrol subsidy again. After di announcement, marketers raise petrol price to N540 within 24 hours. Later di price reach N617, den e reach N897 for September and N1,030 for October bifor dis new increment now.